Things You Don’t Know About Young John “The Wicked Producer” – Pigin Version

Young John The Wicked Producer na record producer and audio engineer for Naija. For plenty plenty songs, you go dey hear “It’s young d wicked producer” and him don dey make wave for Naija sotey even for NET list of Naija top 7 biggest producers, dem rank am No. 3
Check out seven tins wey you no know about Young John
1. Plenty plenty people know am as Young John but d name wey him mama and papa give am wen dem born am na Udomboso John Saviours.
2. Him na just 22 years as dem born am for February 16, 1995 wey make am the youngest Producer for Naija.
3. Young John na correct Akwa ibom boy. The only tin be say dem born am for Ibadan and na dia him live most of him life but now him dey Lagos.
4. Him still be student. As him dey take manage school with him producer life, I no sabi but Young John na student of Communication and Language Arts for the University of Ibadan.
5. Even as Young John never dey endorsed by any company yet, him don already dey No.3 for the list of top 10 best producers for Naija. And at the age of 22, Young John still dey work on improving him career, him know as the beat making business dey change over time. Young John no dey charge anything less dan 500,000 to 700,000 Naira for beat production.
And as industry report take put am, him worth up to 15million Naira.
6. Young John don produce plenty songs especially for dem YBNL people. Some of the hit songs wey him don produce na:
Lil Kesh – Gbese and Efejoku
Davido – Biggest Backside and The Badest
Olamide – Bobo, Story for the gods and Eyan Mayweather
Olamide ft Phyno – 2Kings
Kiss Daniel – Mama

Post a Comment

0 Comments